19/03/2016
07:28 PM
Dear CHUKS
Your gate man say you no dey house, but I dey see ur motor inside compound. I know say e don reach two years wey we see and I know say you you fit still dey vex for me.
Last wednesday, I see your pic for Facebook. Ma mind cum cut, becuz I know say wetin I do u, no good
Water dey full my eye wen I rememba how our luv been dey sweet. E dey pain me say I break your hart....e dey pain me say I return your engagement ring. Na devil work. I swear to God because i love you well well.
E dey like say na becuz of me wey that yoruba girl when dem call Adele sing dat her music, "Hello". My luv, I dey sorry. I still save all your sweet sweet text message for ma fone, wey you dey take totori me for body those days.
I still dey FEEL u, and I hope say we fit come back. I dey sorry and remember say you talk say You no go ever forget me and our love. I don dey think of you tay tay, sotay to chop sef dey hard me.
Abi u don get anoda Boo? If na so, I no go blame u, (e go pain me sha) but I go understand. But I know say no woman fit love you the way me I love you. Remember how e been dey when our love strong kakaraka.
E be like say U don change your numba....I don call am taya. My own neva change. Make we try talk. I dey wait for your answer CHUKWUKA my love.
Na me, your one and only.
YEMI.
Dear YEMI,
I take God name beg u, no near my house again.
Wish kind harmattan breeze blow u cum ma house? Abeg no reach here again O. And how u take see ma pic for FaceBook? Because, me I know say I don unfriend u tay-tay. So na wen u see pic of me inside my new motor u cum rememba me? And which time u start to listen to Adele? Becuz me I no say na only Pasuma, Saheed Osupa or Small doctor u like. No be you been dey talk say Love song na wash? Say no be love person go chop?
Abeg flush!
Devil dey house with him wife dey sleep, him hand no dey dis one. Na your ong-throat cause am. Shebi you don forget say na me be the same Johnny the poor lover boy, the one wey you disgrace everywhere when you talk say you no do again, say you no go die for poverty. Abi now na the poverty you dey find.
Yes, I don get new Boo. D babe fine pass u, WELLA. I think na u wey say I no get moni? I think na u wey call me poor man? U say I no be your level. U say na Rich maga u dey find. Biko go! I thank God say my levels don change. I go soon marry my new Boo. Carry your mumu numba go, becuz I know say the way e dey you now, common credit for fone you no get.
I no want again. I don pass your level. Me and you no be the same category. Abi you wan turn me to your maga? All those days when I been dey cry, dey beg you up and down, even your mama when I been dey help too, pour me dirty water for una house.
Now you wan come back to me. I chop winch? Abi na you chop craze?
If u near ma house again, na dog my gateman go release for u.
Like them Yoruba people say
Koshi!
Person wey no want you again.
CHUKWUKA
[b]Happy Sunday guys[/b] :)