Uh..
Charliebryn on beat
Pass me the mike,I really wan burst..
You dey form admin when u dey site,but for your room e dey hard u to sweep right..
You wan write story since last year,but na only comment wey you use full here..
You post another person story for our site here,you con say na u write ahm jor stop e..
You write one paragraph you dey take form,you wan be better writer you better come fill form..
You claim you came from London,but your writing skill no even reach that of youngjohn..
You dey form big writer you dey post tales,meanwhile na another person story you dey go take..
According to profile on the sites,you're finishing school in the 90s,but according to all friend and tight gees,they say your present age is 19..
#Chorus
(Excuse me,I beg your pardon
Oga This your story no dey add up..
And This your faabu e dey mad gan..
But who am I to take a action..)*2
So I say wehdone sir,wehdone sir,wehdone sir,wehdone sir..
(Tell ahm say wehdone sir,wehdone sir,wehdone sir,wehdone sir..)*2
Your blogger dey chill for him abode,but you still dey find where you go charge you phone,there's no light so nowhere to plug,owner of site dey plug ihn battery dey 4top..
In your small salary you dey buy Mbyte,no sleep for you,you eye dey shine for night..
So you out there looking for network,the thunder wey go fire u still dey do press up..
Blogger get power bank e dey use to charge,when una no get light for house,he still say light no dey make we understand,but his battery don full even before He put the charge..
Use your head this time around,hold the edge of the table make you turn around..
You didn't know when you're pressing phone,and you you say your battery is coming down..
#Chorus
(Excuse me,I beg your pardon
Oga This your story no dey add up..
And This your faabu e dey mad gan..
But who am I to take a action..)*2
So I say wehdone sir,wehdone sir,wehdone sir,wehdone sir..
(Tell ahm say wehdone sir,wehdone sir,wehdone sir,wehdone sir..)*2
Wehdone sir,you don't have a story but you're a world writer? Wehdone sir..
You're into pure water hawking and you say you're government worker..Wehdone sir..
Your name is on Coolval register but you don't come to the assembly wehdone sir..Ride on ride on..
Hope you guys have fun,this Charliebryn/Coolval version,download the original version you're gonna love it..
#Peace out