[b]*Factory don render plenty people for we country jobless, e con make poverty dey run party for we streets anyhow.
*Now, some persons don dey run from Honesty sake of sey Sincerity no dey inside their Dairy anymore.
*Others dey deny their responsibility too sake of sey their stinqy_ness no allow them extend helpinq hands to the helpless fallo.
*Even with chanqe self, children still dey cry tears like rain drops sake of sey no Garri inside H2O (water).
*Imaqine, even with the almiqhty Kainji Dam, NEPA still dey chop qo slow belle fud like sey dem never chop fud for decades, now_ e con make hold Up become Agbero for Aso_Villa.
*No wonder, wey everybody no won plant pikin anyhow sake of sey malaria don build house everywhere.
*Oh ooh! See how friends too dey sneak out of friendship cos dem no won pocket love with empty wallets.
*Now the thing don make hatred full basket join with too much atrocities dey throw_wey, Nah this one con make dem pastors dey plant unity with sincere heart so as to avoid future occurrence of "Had I Know".
*Even with all these UNITY planters, some person self still no even care about the preacher of wisdom cos no sinqle understandinq inside their pocket.
*God Abeq, help shower us ur blissful rain ☔ throuqh the NEW BOSS for we country so that one day we qo fit turn drunkard of H2O wey qet lonq lastinq life & plus 2qether with unendinq prosperity.[/b]