Elizabeth na gal wey me love,i see am 4 street, i come toast am for one corner,in tell me say make i come in church before in go agree for me... Sunday reach,i enter them church on sunday,as choir dey sing,i come see Elizabeth for them middle..As choir dey sing, i dey sing my own self... Me:Elizabeth my love,i need to see you after service oh baby...Elizabeth come reply me...with song self coz we dey hear each other....Na my papa be pastor if in catch you,you don die b dat,as i go look d pastor self...in point hand come meet me,if i see you wif my girl i will handle you myself.... I call Elizabeth number,i dey speak phonetics as a Mushin guy...wey i think say i dey toast my gal...na in mama i dey follow talk,as d woman talk like dis,i run cut phone...I write Elizabeth letter,in read am come leave am for in jean pocket...as househelp dey watch d cloth,in show Elizabeth Sister,Elizabeth Sister Show Elizabeth cousin,Elizabeth cousin show Elizabeth mama,but dem Mama no gree show dem papa coz of my grammar wey fit scatter aso rock,but Elizabeth Papa later see d letter...
Now,Elizabeth,Elizabeth Sister,Elizabeth Cousin and even dem Mama don dey use Flower pursue me while dem Papa dey use Gun pursue me....
Abeg Wetin i go do?