In an examination, Akpors was asked to
complete the following sentences:
1) WAEC : He who fights and run away?
AKPORS : E don surrender be dat, na fear
catch am.
2) WAEC : A rolling stone?
AKPORS: No fit just dey roll, na person push
am.
3) WAEC : He who lives in a glass house?
AKPORS : Na rich politician e go be.
4) WAEC : A stitch in time?
AKPORS : Dey prevent further tear tear.
5) WAEC : Birds of the same feathers
AKPORS : Na de same mama born dem.
6) WAEC : One gud turn?
AKPORS : Na correct power steering fit do am.
7) WAEC : A bird in hand?
AKPORS : Wetin e wan be again if no be
barbeque? Dem plenty for chicken republic
8) WAEC : Half a loaf is better than?
AKPORS : Garri soaking without sugar.
9) WAEC : A journey of a thousand miles?
AKPORS : Na de person wahala be dat na, why
e no enter car or aeroplane jeje?
10) WAEC : He who laugh last?
AKPORS: Get brain problem, make dem examine
am because na beginning of madness.
11) WAEC : A patient dog?
AKPORS : Na hunger go kill am.
12) WAEC : All work and no play?
AKPORS : Na bank job be dat bros.
13) WAEC : Once beaten?
AKPORS : Na revenge go follow be dat.
If you were the one to mark his scripts, what
will you score him out of 100?