Na now I know why dem talk say before you use
anything,
be it electronic gadget or cream, make sure you
read the
manual or the direction on how to use .
I enter my neighbor room this afternoon, naim I see one
cream ontop of him table, and the cream come
resemble
hair relaxer .
A coolval friend promised to
come visit me tomorrow, na im I carry the cream rub for hair,
unto say
make I relax my hair so that e go curl like pastor
chris own,
just to look good
. I rub the cream for head, rub for my beads even
rub for
eyebrow,,,, I sit down dey wait make my hair curl
before I go
wash the cream comot
. As I dey wait, naim one mind say make I even read
wetin
dem write for the body of the cream,,, my people,,,
tears
comot for my eyes when I discover say na Hair
Remover naim I carry rub for head, for beads and even for
eyebrow
. I think say na joke until all the hair wey dey my
head begin
fall one by one like fowl wey dem put for hot water
. As I dey talk to you so, I come resemble person
wey dem be wan take do ritual, wey escape
.
My problem now be say...... How me wan take
convince my
coolval friend wey wan visit me tomorrow say na me be Olanrewaju
.
Because right now .... Am not the guy I used to
know.... Am
the shadow of myself #Lol.