Dem say lassa fever don dey garri after I buy half
bag for house...I come say make I test am if na
tru,I soak garri put milk inside cum give my dog
Bingo , make him first test am. 45mins later, bingo
still dey waka, dey jolly. Nai i drink my own. After
i don drink am finish, my gateman run come tel
me say bingo don die, hey! I run enter house,
begin drink full gallon of palm oil for my belle,
chop 22 bitter kola wit 3 long bitter leaf stem,
chop walnuts with the shell no time to crack,
swallow moringa with aloe vera as treatment
combo. Garlic and onions be like sweet for my
mouth. I come dey sweat as if na oven be my
bedroom. I dey think say my life don finish. I
come outside. Nai my gate man com they tell me
say the driver wey kill bingo wan come beg me! If
na u, wetin u go do the gate man?