HILARIOUS FACTS.
•
The Chicken wey run away from borno go
ibadan go still end up inside pot of soup;
YOU CANT RUN AWAY FROM UR DESTINY.
Todays newspaper na tomorrow suya wrap:
KEEP CALM NOTHING LAST FOREVER.
Cow wey dey in a hurry to go America go
come back as corn beef: JUST BE PATIENT LET
THE GAME COME TO YOU,DONT RUSH. Akara
and moinmoin get the same parent, na
wetin dem pass through make dem
different: HOW YOU START DOESN'T
MATTER,WHAT MATTERS IS HOW YOU FINISH.
If life show you pepper,my guy make pepper
soup from it: MAKE SOMETHING GOOD OUT OF
A BAD EXPERIENCE. I get am before no be
property: STOP LIVING IN THE PAST AND
START LIVING IN THE PRESENT.
If person too tey for party e go follow dem
wash plate: DONT OUTSTAY UR WELCOME.
Craze no hard to form na d trekking be
wahala: EASIER SAID THAN DONE.
No matter how hot ur temper be,e no fit boil
beans: CALM DOWN, YOUR TEMPER WON'T
SOLVE THE PROBLEM.
Every mallam with im own kettle,every
northerner with im own radio: EVERY MAN
FOR HIMSELF.
Opolo eye no be open eye: HAVING BIG EYES
DOESN'T MAKE YOU CIVILISED.
Bring suya...bring suya,na cow body dey
suffer am: EVERY ACTION HAS A
CONSEQUENCE.
E go better E go better na im make ibo man
still dey kano: WHEN THERE IS LIFE THERE IS
HOPE.
The difference between igbekere and
plantain chips na packaging: DONT JUDGE
BASED ON APPEARANCE ALONE.
Escort me escort me,na so slave trade take
start: SERIOUS THINGS SOMETIMES START LIKE
JOKE.
Pikin wey use agbada take start,abeg wetin
e go wear wen e old: SLOW AND STEADY
WINS THE RACE.
The water wey dem use make eba can never
be recovered back: DONT CRY OVER SPILLED
MILK............darling COOL DOWN
•..#Dammy...