THE FINAL PART OF KUSI
As Imma dey urge me to tell her about my girlfriend I come gather courage say make I tell her as e
take hold me, make I tell her how I dey feel for where she dey, anything wey go happen make e
happen, I don tire to dey pretend and to dey fear
“me... I no get girlfriend for now Imma, but I get one person for mind, this person don become part
of me but I never fit tellam wetin she mean to me, she matter pass for my life, but I no wan cross
my boundary because she just talk say I be her younger brother…me wey don do wedding finish
with her for dream e come remain to start family together, but I no even know wetin I fit
talk…make she no go break my head as she dey see me as her younger brother… Imma, make
we leave joke aside, na you my heart dey beat for, I love you Imma, I no fit pretend again, I no fit
keep the kind feeling wey I get for you for my heart before my heart go blow, na you I want no
woman again matter to me like you, na you matter pass for my life, but I wan still know…make you
no vex Imma…you get person already…I mean you get boy abi man friend….so that I go know
how I go take cry… e go pain me well well but I go try endure, the truth be say I never fit love
another woman the way I take love you…na you I want…only you Imma…I wan kno….
Before I go talk finish she just rush me, the rushing sef surprise me, she come give me one better
hug wey I no expect...she hold me tight, me I come hold her too, we stay like that for some
minutes, she no wan leave me, me sef I no wan leavam, but I never know what to expect, I just
they pray make this hug be better hug, I just dey feel her heart beat, na she be the woman I don
carry for mind, my feeling for where she dey strong well well, na she I go like spend the rest of
my life with if God allows it, I wish she go accept me
I get my own personal office for shop, na there we just hold ourselves as if the world wan end, she
later come leave me, come hold my hand, I see small tears for her eyes she dey try to hide, but I
just sit down there they look her, as I look into her eye I know say she has feeling too for me but I
wan make she take her mouth talkam…
And she later talk.. Making me the happiest man alive, “I have always waited for this, not just now…but for a very long time, I have secretly prayed that
you will ask me out, I have loved you Kusi right from when I was still pregnant for my daughter,
few months after you saved me and took me to your mother, I began having feelings, I watched
you hustle morning and night no relenting, you worked so hard and carried everybody’s burden
like yours, the day you got me the cloths during my pregnancy was one of the happiest day of my
life, I felt so care for that I didn’t even want to call my parents even after you and your mom urged
me, I didn’t want to be far away from you Kusi, because I know they may take me away from you
and I may not see you again, I always wanted to be close to you, when other young boys of your
age then where enjoying their lives you were busy working so hard to feed many mouths, you and
your mum, do you know that I like it when the market women back then will refer you as my
husband, when I was pregnant, they will be calling you my husband because they thought you the
man that got me pregnant and you will answer them positively, you accepted me without fault and
covered my shame, I always wanted you to ask me to be your girlfriend, I couldn’t just come out
straight because I was shy and didn’t know how you are going to feel about it, you know back in
school whenever we talk over the phone and you tell me to focus on my book and don’t allow any
man to deceive me I will just be laughing because you are always sounding and acting as like an
elder, like you were older than me with ten years, and I loved it, I have looked forward to this day
Kusimala Isaac, and to answer your question I don’t have any boy or man friend, I had guys
coming but I always dismiss them with I have a boyfriend, I will always tell them to leave me alone
because I have a boyfriend, and you were my imaginary boyfriend, I have prayed and crossed my
finger with hope that you will not have any woman and you will eventually ask me out, I don’t care
about your educational background, or anything else, all that matters to me is you, I even envy
your polished pidgin English…hahahaha…and I wish I can speak it so fluently like you….so that
we can both be on same level, and crack our ribs sometime, but no matter what I will love and
support you, what my parents did to show gratitude to you and your mum for saving me was even
small, I can never stop thanking God for you and also your mum, you are really God sent, as my
Dad will always say that Kusi is the man God sent on mission to save you from dying, my Dad said
they were praying for me all through that period and God answered their prayer by sending Kusi to
that bridge, you losing your money that day was God’s own plan so that he can direct your step to
the bridge to save a naïve young girl like me, you gave me reason to live and smile, my daughter
is my blessing but there wouldn’t have being a daughter if I had jumped to my death that day, I’m
not just loving you because you saved me, more because you are a man filled with strength, kind
heart, originality and love for humanity, what more can I ask than that, my Dad will be glad to have
you beside me, and hope you don’t mind if I take you to see my Dad because he made me
promise him that I will bring down any man I intend to go into a relationship with, he will like to see
and know the man, he doesn’t want me to make same mistake I made in my previous relationship,
so please will you go with me...
Hope say no be dream I dey dream so, abeg make person pinch me small so that I go know say
na reality be this,
as Imma just they talk na so so smile I just dey smile, so na so God come answer my prayer, Anywhere she want make we go, I ready to go with her, na she be the only woman my heart dey
always beat for, I no even know say she don dey wait for me to toast her since, if I know I for don
toast her tey tey na, wetin I dey wait for again, we for don dey relationship since but she for don
carry another belle be that, because my blood dey hot for where she dey, hahahaha… my mind
dey sweet me well well, na like this God want everything to go and I dey happy,
And e come be now wey she don dey finish school, I happy no be small, I still thank God say I no
ask her out that time as e take hold me for body who know wetin for don happen, because this our
love na strong something.
After three days I come drive with her to her papa house, the pastor and his wife dey happy too,
dey even come dey talk say na so God ordain two of us, the family accept me and they like me,
Imma mama come gather her chef, people wey dey cook for her, dem come prepare better food,
na so all of us come sit down round the table as if we be one family, come dey eat and dey gist,
life don better for me, I no fit shout. Imma papa give us plenty advice, the advice come be like
preaching for my ear and the one wey I no fit forget na the last part, the pastor talk say make we
hold our body well well, the pastor talkam like this,
“respect your partner, both presence and absence, and among all this things I have spoken the
most important is… avoid premarital sex, God dislike it, you know the bible said in the book of
Corinthians that every sin that a man commits is outside the body but the sin of sexual intercourse
is a sin against his own body, because… you know that your body is a temple of the Lord, do not
defy God’s temple…
The man sabi talk plenty talk, as him be pastor every talk na bible and preaching, the advice come
be like say na church wey dey, na long sermon him preach that day for us, I no go lie the talk tire
me but na the truth him talk, me I already know that one, even though my blood they boil for where
Imma dey I go just dey patient, I go wait for the right time.
Later Imma come go back to school to go finish up, our phone call come increase, na every
minute we dey talk for phone, Imma always dey respectful me, and na so me dey respect her too,
After she finish school, she come back house, I dey always carry her out sometime to go flex,
one day I done already plan wetin go happen that day even God sef don ordain the thing, as we
go flex, after the whole grooving, I come carry her enter my office for my shop, to show say I dey
romantic na so I come go down for one kneel, I even thank God say I still remember na one kneel
I suppose use no be two kneels, because I don almost fall her hand, I know say na laugh she for
laugh me,
As a correct guy wey I be na so I kneel down for one kneel come ask her the question, abeg time
no dey again, make we do sharp sharp settle down, before person go fall into sin, as I ask her
whether she go fit marry me, na so Imma just dey scream yes…yes…
even my shop boys wey dey outside come inside come dey watch us as if na film me dey act, all
of dem just dey smile as they stand for my office door wey I leave open they watch our drama, asshe say yes I come forget say I no get ring to put for her finger,
Everybody come dey laugh me, I follow dey laugh my self, I forget to buy ring, I forget say them
dey use ring propose to a woman,
as I still dey reason wetin I go do, na so my boys rush go outside go make one fake ring with car
wire come give me so that everything go be official, I collect the fake ring come put for Imma
finger, she just dey laugh, na later I come drive go one better ring shop come buy original
engagement ring for her, as I come back I come commot the fake one wey still dey her finger
come carry the original one put, she just dey smile come hug me, she come kiss me small, just
small kiss, we no wan trespass.
The food wey we dey cook don almost ready, we go still chopam any how we want, no need to
rush the food for fire, after all na we gettam. Na proverb be this. Make we no rush ourselves, e just
remain small everything go set.
Na so the marriage preparation come start, my mama happy everybody happy as me and Imma
dey prepare to marry,
Then finally, the day wey we don dey wait for come finally reach, my younger brother na him do
best man for me, Imma beautiful daughter be the little flower girl, wey just dey spray flower for
road, the little girl resemble Imma well well, with her fine smile, na so she just they match in front
of her mama,
As I stand there, close to the pulpit, I see plenty people wey come wedding full ground, I see my
mama dey smile, my sister them follow for Imma’s bridesmaid, all of them just fine, everything just
dey beautiful,
I come see Imma dey come with her papa, as the music they play, slow gospel music, na so she
just dey match with her papa, wey hold her for hand as they walk down the aisle, my heart wan
boast with joy, na so one small tears just drop for my eye, my best man wey be my younger
brother just stretch hand give me handkerchief to clean,
Imma papa come carry her give me, and after we don exchange our vow, na so the pastor
pronouns us husband and wife, and finally I kissed my bride for live no be for dream,
“I Kusimala Isaac took Immaculate Johnson to be my lawful wedded wife and not even death fit
separate us, I go always love her with my life.
So my people na reception we don enter so, and the asoebi colour na blue with yellow gele, but
the asoebi no dey compulsory come as you are, party jelllof rice dey plenty, food full ground and
na serve yourself, you go chop belleful,
My name na Kusimala Isaac and Is good make person dey do good, abeg make we dey always
do good so that our tomorrow go better,
And no forget say “One good turn deserve another”, na so oyibo talkam.
Na for here I go draw the curtain for this my story,
Abeg call me Kusi the man wey get faith.
Na the END be this.