E get one particular restaurant wey i dey go
chop 4 G.R.A. E get one oyinbo wey dey always
come chop there too...
Anytime dis oyinbo chop finish, he go shout
''Hey'', so I wonder wetin dey make am shout. I
decided to chop wetin d oyinbo dey always
chop so maybe me self go shout too. When I
reach d restaurant yesterday evening, I order
wetin d man dey chop. Dem tell me say na
chicken & red wine, so i chop am finish, i no
shout.
I collect extra plate, but i no still shout. I say
dis oyinbo na mumu o, wetin dey make am
shout like dat? Na so i just vex ask 4 my bill.
The waiter tell me say one plate of chicken &
red wine na N75,000 then d extra plate too na
another N75,000. Na then I shout hey! heyy!!
heyyy!!! heyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyy
yyyyyyyyyyyyyyy
yyyyyyyyyyyyyy yyyyyyyyyyyy...........Up till
now, I still dey shout ....
No laugh alone oo