Dem say boko haram don poison beans
after I buy half bag for house, from d
one wey i cook, i give my dog, Bingo,
make im test ham.. 45 mins later after
bingo finished d beans, bingo stil dey waka dey jolly. Na im i con chop my
own. After i don chop finish, my
gateman run come nd tel me say bingo
don die, hey!! I run enta house, begin
drink full gallon of palm oil for my belle..
Chop 22 bitter kolanut with 3 long bitter stem, chop walnuts with d shell no time
to crack, swallow moringa with aloe
vera as treatment combo. Garlic nd
onion be lyk sweet 4 my mouth. I cum
dey sweat as if na oven be my bedrum,
i dey think say my lyf don finish. I cum outside na im my gateman cum tel me
say d driver wey kil bingo go come beg
me.. Chai!! I fainted..
If na u wetin u go do d gateman.. Lolz….
Hapi Sunday palz