My Coolvalites abeg help me thank God oh..The girl wey I bin wan divorce(we never marry o) all this years but no wan go don finally leave me herself o..
As I dey stroll for my area na so I Kon saw the girl coming(actually ruNning) to my direction to hug me,as she wan reach me remain small gap.I shift small,set my leg there,the next thing I see na say she don reach ground
GIRL: what's tha for?
ME: I dey fast
GIRL: pull me up (she stretch her hand)
Me: I can't touch, I dey fast
GIRL: what! Its over between us..
I just dey dance since then,na drummers I need now make dem dey beat drum,but wait o shey I really no touch?
RAMADAN KAREEM