TOO MUCH GRAMMAR DEY CAUSE TROUBLE O...
I enter this Cross- Country bus from Abuja to
Benin yesterday.
As we dey go for road one man for back say
'driver I am impressed.' The driver com say
'thank
you sir.' We never reach Lokoja wen the
man tell driver
again, 'driver I am impressed.' The driver
come
thank the man again.
Before we comot for Lokoja the man don
thunder
again say, 'driver I am impressed.' The driver
come say, 'thank you very much sir, I very
much appreciate your compliments.'
The driver begin dey fire the bus dey go
come dey
feel like James Bond.
As we reach Okene the man shout 'driver
stop
this bus, stop this bus, you mad, you wan kill
person?' As driver stop the bus the man run
comot like
Usain Bolt enter bush.
We rush follow the man make we see wetin
dey
impress the man.
Before we reach where the man dey we
hear pra
pra pratata pro pro! Na there we come
realise say wetin the man wan
tell driver be, 'driver I am pressed'
I take God beg all of una... If the English hard
small, una fit talk am for pidgin.
Meanwhile... I am pressed right now, make I
rush
discharge... I dey come.
#CopieD