Na only 4 naija you go see fish inside MEAT PIE....
Na only 4 naija we dey count money after we
withdraw am 4rm ATM cus we no even trust ATM
machines......
Na only 4 naija PHCN dey do promo sayin ''win a brand new generator'' if u pay ur lite bill......
Na only 4 naija pple dae horn 4 traffic lite make e
quick change from Red to Green....
Na only 4 naija pharmacy dae sell coke, recharge
card, beer nd puff puff....
Wetin u no see for naija u no fit see am anywre in the world, Trust me.....
Na only 4 naija u go find a graduate of mechanical
engineering dae do him NYSC 4 police station......
Na only 4 naija u go see 1 person dea use BOLD5, X3,
IPAD2 nd nokia N8 all at once but him mama dae sell
akara nd bread 4 jungle..... Na only 4 naija u go see a graduate of Law work as
generator repairer......
Na 4 naija only u go see madman dae control traffic,
pple wey head correct dae obey.....
Na only 4 naija u go see the president senior the
country himself.... Na only 4 naija u go see native doctor dae use Laptop
connected with MTN modem(maybe dae are now
consulting the spirits online).......
Na only naija u go see a man selling a book from
street to street title 'HOW TO MAKE MONEY WITHOUT
STRESS'( i wonder y him no read the book)..... I SALUTE NIGERIANS- GOD BLESS NAIJA.......