Hello future Mrs. Ele
This poem wey I dey post no be sere
Abeg for now forget good English
This poem dey distinguish
Dem say emotion nah get language
That’s why I dey use pidgin drop this package
I nah say some people still dey wonder why
My people na long story, but I go soon try
Future Mrs. Ele don make me high in love
The feelings dey sweet me for belle like puffpuff
I swear I wan die on top her mata
The bae just too gada
This one no be flatter
The bae just make my head scatter
Future Mrs. Ele, wetin you do or where you come from no mata
You and I go start a fresh chapter
I nah fit front say I dey live extra large
But with our hustle together cars go fill our garage
Shebi Buhari dey travel round the continents?
Me go carry you travel round the planets
I nah fit wait for u to become my wife my dear
your type just to scarce @blair