Kai Ramadan again .... See how dos meat big
for inside pot .....ah no fit touch am ....chai
....see different scent of stew especially
champion and delta kitchen ... See how
gidigba they chop chicken lap and my throat
dey vibrate ....see how iya baff dey sell
pomo..... Even maale for field dey sell bombay
i.e. Fufu and eba..... Even mama d mama aka
iya amina no carry last for d beans ....chai
......na all this things i go miss for thirty days
...dere is God o
....... Ah neva fast reach anywhere my nicker
don dey fall.... Na so thirty days wan long
go.......... See turkey ,pomo.....eja, chicken wey
dem dey dash me dis afternoon ah no fit
collect ..... God dey sha .... Even my xtian
friends wey dey always hide their food from
me come dey carry am like show logo for
mah presence ....make una no worry e go
still end noni shey no be next month ni ? Even my lover @Jummybabe dey use food do shakara for me ..... Ah swear mah no lie e dey do me as if make i carry dis big meat wey dey pot chop ...who wan know .... What do u think @coolvallers