Dem say boko haram don poison beans and i
buy half bag for house. From di one wey i
cook, i giv my dog ‘bingo’ make e first test
am, 45mins lata bingo stil dey waka, I dey
jolly den i eat my own. Afta i eat finish, my
gateman run come tel me say bingo don die,
hey! I run enta house and drink full gallon of
palm oil for my belle. I dey tink my life come
outside, my gateman com dey tell me say di
driver wey kill bingo wan come beg me. If na
u, wetin u go do di gateman?