Can't stop laughing...
*Na only for Nigeria you
go see fish inside
"MEAT PIE"..
*Na only for Nigeria we
dey count money after
we withdraw am from
ATM because we no
even trust ATM
machines.
*Na only for Nigeria
PHCN dey say:-Win a
brand new GENERATOR
if you pay your NEPA
bill...
*Na only for Naija
people dey horn for
traffic light make e
quick change from Red
to Green...
*Na only for Nigeria
Pharmacy dey sell Coke,
Recharge Card, Chin
chin,Puff puff and beer,
Wetin you no see for
Naija, you no fit see am
anywhere in d world...
*Trust me. Na only 4
naija you go find a
graduate of mechanical
engineering dey do him
NYSC 4 Police station.
*Na only 4 naija you go
see one person dey use
Bold5, X3, Ipad2 and
Nokia N8 all at once
while his mother dey
sale akara and bread for
jungle.
*Na only 4 naija you go
see a graduate of law
dey work as generator
repairer.
*Na 4 only Naija, you go
see mad man dey
control traffic, people
wey their head correct
dey obey...
*Na 4 only Naija, wey
you go see the
president senior the
country himself.
*Na 4 only Naija, you go
see native doctor dey
use laptop connected
with MTN modem.
Maybe they are now
consulting the spirits
online..
*Na only for naija u go
see a man selling a book
from street to street
dat says HOW TO MAKE
MONEY WITHOUT
STRESS. I wonder why
him no read d book. I
salute una Nigerians....
Naija no dey carry last..
Na only 4 Naija u go see person
read
this my joke finish without
commenting.lol